Ehen, who be dis woman sef? This message na because for Bible, dem write big-big English especially if na KJV you dey use but no wahala, make we break am down for Pidgin so everybody fit understand beacuse the matter serious well well.
The truth be say, this Mystery Babylon no be one particular woman or city. Na one very powerful system for this world wey dey deceive people and fight against God. As e dey for Revelation, na im be the number one enemy for God people.
Wetin Bible Talk About Am?
- Fine Woman Wey No Good: Dem dress her with costly purple and red cloth, plenty gold and jewel (Revelation 17:4). Outside she fine die.
- But Inside Na Poison: For her hand, she get one golden cup. But inside the cup na pure dirty and bad bad things full inside. Outside dey shine, inside dey rotten. Nawa for dis kain woman sha, no wonder Bible dey warn us.
- Name wey she dey answer: for her forehead dem write: “MYSTERY, BABYLON THE GREAT, MAMA OF ALL ASHEWO.” “Mystery” mean say you need to look well to know who and wetin she really be.
- She Don Kill Plenty People: She don get high from the blood of Christians wey dem kill because of Jesus (Revelation 17:6).
- She Dey Control Presidents and Kings: She dey ride one scary animal with 7 heads and 10 horns. That animal represent government power. So she be the one dey control and use all the government power for this world.
So, Who She Be For Real?
Na three main things she represent:
1. Fake Religion System
If the real Church of Christ be like fine bride, this Mystery Babylon na ashawo wey no good. Na any church or religious group wey:
- Dey preach another gospel wey no be the true one for Bible.
- Love money and government power pass Jesus.
- Dey follow government join hand to persecute true believers.
2. Greedy Money System
When Babylon fall for Revelation 18, na the big-big businessmen and importers go dey cry pass. Why? Because their don finish.
So she also be:
- The world system of greed and “man must chop”.
- The love of luxury and good life wey make people forget God.
- System wey dey use human beings like say na product.
3. The World Wey No Want God
For inside, na the spirit of the world wey dey say:
- “We no need God. We fit rule ourselves.”
- “Just dey enjoy life, find money, make yourself happy.”
- “If e sweet you, do am.”
Wetin Go Happen to Her For Last Last?

The kain thing wey go happen go shock you. That animal wey she dey ride (the government power) go LAST LAST turn against her.
The kings wey she been dey use take scattr the world go change their mind, gocome hate her, naked her, chop her flesh, and burn her with fire (Revelation 17:16).
God go use bad thing to destroy bad thing. She go fall yakata suddenly. All the rich people for the world go dey cry, but for heaven, angels and saints go dey shout “Hallelujah!” (Revelation 19:1-2).

Wetin Be The Lesson For You And Me?
Before all this thing go happen, God go don dey shout warning to all Him people but dem go gree hear?:
“Make my people commot from that place, so that una no go follow her share for her sins, and una no go collect any of her sickness.” (Revelation 18:4) Pidgin English Bible
This one na the most important part. To “commot from her” no mean say you run go for bush oo go dey stay.
E just means say Na to:
- No fall in love with the ways of this world.
- No let their luxury flexing and lies confuse you come go join dem.
- No join yourself with anything wey dey hate God.
- Make your mind and your heart dey with Jesus always.
So, summary be say: Mystery Babylon na the world system of fake church, greedy money lovers, and sinful life. E fine for outside but e dey lead to death. God go destroy am. Our work be to make sure say we no love the world thing pass how we love God.
